Biblia Todo Logo
Bìoball air-loidhne

- Sanasan -




Jeremaya 31:15 - Holy Bible Nigerian Pidgin English

15 God sey, “Pipol hear kry and shaut for Rama. Rashel dey kry for en pikin dem wey don die and nor-tin wey pipol tok, fit konfort am.”

Faic an caibideil Dèan lethbhreac




Jeremaya 31:15
18 Iomraidhean Croise  

So Rashel die and dem beri am for di road wey dem dey pass go Efrat (wey bi Betlehem naw).


All en sons and dotas stand near am dey kounsol am, but e nor gri ansa dem. So Jakob kon kry well-well for Josef.


En brodas ansa, “Yor savants na from one house and wi bi twelf boys. Na one man for Kanaan born all of us. Di one wey yong pass dey with awa papa and one don die.”


So dia papa Jakob kon tell dem, “Una won turn mi to who nor get pikin? Josef don die. I nor know wetin dey happen to Simeon naw. And naw una won kollect Benjamin too! Evritin just dey against mi.”


Enoch waka with God, den e vanish, bikos God take am.


Yu nor fit just forgive mi my sins? Yu nor fit just sorry for all di bad tins wey I do? I go soon die and wen Yu dey look for mi, I go don go.”


but wen I look again, I si sey dem don die go! Even doh I look evriwhere weda I go si dem, I nor si dem again!


Wen I dey trobol, I look for God. Thru-out di nite, I pray and lift my hand go heaven, but nor-tin fit konfort my soul.


den dem cross kon go sleep for Gibeah dat nite! Pipol for Rama town dey fear and di pipol wey dey for Saul village for Gibeah, don run komot der.


So I kon sey, “Make nobody hold mi; make una allow mi kry well-well. Make I kry for my pipol, bikos dem don distroy dem and nobody dey to help dem.”


Dem don distroy awa house and di rope wey bin whole di house togeda, don kut. Dem don karry awa shidren go as slave and dem nor go kom back again, bikos of dat, nobody dey to help us build awa house or hang di curtains again.”


God tok to mi afta Nebuzaradan, wey bi di sojas oga don free mi for Rama. Na shain dem bin take dey karry mi as prisona go Babilon with all di oda pipol from Jerusalem and Judah.


Na awa grand-grand papa dem sin and dem don die, but naw, wi dey sofa dia ponishment.


Di hand open di book and dem rite put for di two side. Na kry, mourning and pains dem rite put for di book.


E dey always sidan under one palm tree wey dey between Rama and Bethel for Efraim hill kountry and Israel pipol dey go der go meet am, make e judge dem.


Den e go kom back to Rama, bikos en house dey der. E still dey judge Israel pipol for der and e build one altar for der wey dem for dey woship God.


Lean sinn:

Sanasan


Sanasan