Biblia Todo Logo
Bìoball air-loidhne

- Sanasan -




Jeremaya 31:11 - Holy Bible Nigerian Pidgin English

11 God go free and save Israel pipol from strong nashons wey dey opress dem.

Faic an caibideil Dèan lethbhreac




Jeremaya 31:11
19 Iomraidhean Croise  

Make Yu hear my prayers, bikos I don taya. Make Yu save mi from pipol wey dey opress mi, bikos dem too strong for mi.


Betta fear go katch dem and with yor great pawa, dem go bi like stone kon dey fear until di pipol wey Yu save, go waka pass.


Heavens, make una shaut dey happy! All di deep part for dis eart, make una shaut well-well! Make mountins and evry tree for di forest, shaut too, bikos God protet Israel pipol kon show how E great rish.


So naw, make una komot from Babilon, make una run komot from der! Make una shaut with joy as una dey tok about am. Make una tell evribody for di world sey, ‘God don save Jakob en savant.’


So na who go fit seize wetin soja karry kom from war? Una fit go release doz wey strong men katch?


But dis na wetin God tok: “True-true, dem go release doz wey dey prison and dem go seize wetin strong men karry kom from war. I go fight with anybody wey fight with una kon save una shidren.


Doz wey Yu don save go rish Jerusalem with joy, dem go dey sing and shaut with happiness. Dem go dey happy and dey free from sorrow forever.


I go save yu from wiked pipol and doz wey like trobol.” Mi, wey bi God, don tok.


God wey dey mighty sey, “Dem dey opress Israel and Judah pipol. Doz wey katch dem don turn dem to prisonas. Dem nor gri let dem go.


But di Pesin wey go save dem, dey strong. Dem dey koll am Oga God wey dey rule ova evritin. E go fight for dem kon bring peace and rest kom di eart, but na trobol, wahala and pain go follow Babilon pipol.”


Oga God, na Yu bi my lawyer, so make Yu judge my kase, bikos Yu don save my life.


I nor go save dis pipol from grave or save dem from deat pawa. So deat, make yu bring all yor wahala kom! Yu grave, make yu bring all yor distroshon kom, bikos I nor go pity for dis pipol again.


Wen dat day rish, just as shepad dey save en animals from danger, na so too Oga God go save en pipol. Dem go shine for en land like crown wey dem make with gold.


“How pesin go fit break enter strong man house kon tif en propaty, unless e first tie di strong man? Den, e go get shance tif wetin dey di house.


just as Man Pikin nor kom make pipol serve am, but make e for serve and give en life to save many pipol.”


Jesus ansa dem, “Una dey make mistake, bikos una nor know God word and en pawa.


E die for us, so dat e go free and klean us from wikedness kon turn us to en own pipol wey like to do good tins.


Lean sinn:

Sanasan


Sanasan