God sey, “Di time dey kom wen I go choose betta king from among David shidren-shidren. E go rule di land with wisdom kon do wetin dey korrect and good.
Bikos I know wetin I plan for una; my plan na to make una prosper, nor bi to give una wahala and na to give una di kind future wey una dey hope to get.
Dia leaders go kom from dia own nashon and dia prince go bi dia own pipol. E go kom meet mi wen I invite am, bikos nobody go fit kom wen dem nor invite am.
But di time dey kom wen Israel pipol go turn kom meet Oga God and one among David shidren-shidren, go bi dia king. Den dem go fear God and E go bless dem.