Biblia Todo Logo
Bìoball air-loidhne

- Sanasan -




Jeremaya 30:8 - Holy Bible Nigerian Pidgin English

8 God sey: “Wen dat day go kom, I go remove di load wey dey dia neck kon break di shain and dem nor go bi slave to strenjas again.

Faic an caibideil Dèan lethbhreac




Jeremaya 30:8
16 Iomraidhean Croise  

E komot dem from di darkness kon break di shains.


Wen dat time rish, I go free una from Assyria pipol pawa and dem nor go bi load for una shoulder again. I go free una, bikos dia load go too dey heavy for una to karry.”


Oga God go pity en pipol, Israel. E go choose dem as en own kon let dem stay di land again and strenjas go kon stay der with dem.


I go distroy Assyria pipol for my land. I go skata dem put under my hill. I go free my pipol and remove di load wey Assyria pipol put for dia shoulder.


Wen God don free Israel pipol from dia pain, sofa and di hard work wey dem force dem to do,


All dis joy na bikos Yu don remove dia heavy load and di kane wey dem take dey flog dem. Yu don defeat di pipol wey dey tif and opress oda pipol, just as Yu bin defeat Midian sojas.


“E don tey wen una rijet my kommand or obey and woship mi. Instead, una give unasef to all di gods wey dey di hill and under evry green tree, like sey una bi ashawo wey dey find who e go sleep with.


I go pay Babilon pipol back for wetin dem do and dem go bi slave to many nashon and great kings.’ ”


“Make yu tie leda rope for wood kon put am for yor neck,


All di nashons go serve en and en shidren-shidren, until wen en own nashon go fall. Den Babilon go bi savant to nashons wey get pawa and great kings.


Hananaya take di wood wey dem tie for my neck komot kon break am to pieces,


I go tell Hananaya: “Yu don really break di yoke wey dem make with wood, but naw, na iron yoke yu don put for where e bin dey.


Jehoiashin wey bi Jehoiakim pikin and all Judah pipol wey go Babilon as slave, I go bring dem kom back. Yes! I go break Babilon king pawa. Mi, wey bi God, don tok.’ ”


Darkness go kover Tahpanhes town wen I break and end di pawa wey Egypt get, wey make dem dey make mout and karry body up. Kloud go kover Egypt and all di pipol wey dey inside. Den sojas go katch and karry all of dem go prison.


Dia tree go bear fruits; dia fields go bear betta plant and evribody go stay for peace for en land. Wen I don break di shain wey dem take tie my pipol kon free dem from pipol wey dey trit dem like slave, den dem go know sey na mi bi God.


Naw, I go skata and distroy Assyria pipol and dem nor go worry my pipol again.”


Lean sinn:

Sanasan


Sanasan