Biblia Todo Logo
Bìoball air-loidhne

- Sanasan -




Jeremaya 30:7 - Holy Bible Nigerian Pidgin English

7 Di day wen una go face sirious wahala dey kom and dem nor go fit kompare am with any oda day. Even doh di wahala go too mush for my pipol, dem go survive am.”

Faic an caibideil Dèan lethbhreac




Jeremaya 30:7
37 Iomraidhean Croise  

Den Jakob kon dey fear and en mind nor setol. E divide both di pipol wey dey with am and di animals into two group,


So my God, make Yu save Israel pipol from all dia trobols.


Pipol wey dey do wetin dey rite, dey face trobol well-well, but God go save dem from all dia wahala.


For dat time, pipol wey dey stay near di river go sey, ‘Si wetin don happen to di place where wi bin put awa hope; so na where wi go run go make dem help us naw? Na where wi dey espect sey, wi go dey save from Assyria king? How wi go fit take eskape naw?’ ”


Yet, na Yu bi di only hope wey Israel get; na Yu save us from wahala. So naw, why Yu kon bi like strenja for awa land or like pesin wey dey travel kon branch stay for one nite?


Una wey sey na tree bi una papa and rock na una mama, God go disgrace una. Dis tins go happen, bikos instead of una to follow mi, una kon waka leave mi. But anytime una dey for trobol, una go sey make I kom save una.


Where di gods wey una make for unasef? Wen ever una dey for trobol, make dem kom save una if dem fit! True-true, di gods wey dey Judah many like di towns wey dem get.


My pipol, make una nor fear; make Israel pipol nor fear at-all. I go save una from di far land where una dey as prisonas. Una go kom back to una house kon stay for peace and nobody go make una fear again.


Una wey dey waka pass, my sofa nor mean anytin to una? Make una look round, una si anybody wey dey sofa like mi? But na God vexnashon dey kause dis pain and sofa for mi.


Wetin I go fit tok? Who don ever si dis kind sofa before? Wetin I go fit take kompare yu, Jerusalem? How I go fit take konfort yu? Bikos di wound wey yu wound, deep like sea. Na who go fit heal yu?


Di ponishment wey I give my pipol worse pass Sodom pipol own, bikos na wons e take happen and nobody dey to help dem.


“Den Mikael; di great prince wey dey guide yor pipol, go appear. Dat na wahala time and dis kind wahala neva happen for anywhere kom rish naw. But yor own pipol wey dia name dey di book wey get life, go eskape.


Yu don do wetin Yu sey Yu go do wi and awa leaders. For all di towns wey dey for dis world, na Jerusalem Yu dey ponish pass.


Den Judah and Israel pipol go kom togeda as one again. Dem go choose one pesin wey go lead dem and dem go plenty kon prosper for dia land again. Yes! Dat day for Jezrel, go dey great well-well!


God day don near, di day wen di Almighty go distroy evriwhere. Dat day go bad well-well!


Una wey bi leaders, make una listin! Evribody wey dey stay dis land, make una listin well-well. Anytin like dis don ever happen for una time or for una grand-grand papa dem time?


God vois bi like tonda as E dey lead en sojas wey nobody fit kount. And doz wey dey obey en kommand, many and strong well-well. Di day wey God choose go great well-well, so na who go fit survive am?


Di sun go turn to darkness and di moon go turn to blood. All dis tins go happen before di great day wey God don choose, go kom.


But naw, wetin make una dey shaut and kry? Una nor get king to lead una? Abi dem don kill una wise men finish? So wetin make una dey feel pain like woman wey won born?


I fear well-well wen I hear all dis tins and my lips kon dey shake. Fear and kold katch mi at wons. I go really wait for di time wen God go ponish doz wey dey attack us.


But e go happen for one special day and na only Oga God know di day. Normal day and nite go dey and even wen evening rish, lite go still dey shine like day time.


Oga God sey, “True-true, Judgement day dey kom; e go kom like strong fire. All doz sturbon and wiked pipol go fall and dat day dem go burn die. Both dia rut and branches go burn finish.


Bikos wen dis tins go dey happen, di kind sofa wey go dey, neva dey since wen God kreate dis world and dat kind sofa, nor go dey again.


Di sun go black and di moon go red like blood, before di big day wen God tok about, go rish.


Na so God go save all Israel pipol just as en word sey: “Di pesin wey go save Israel pipol go kom from Zion, den Jakob shidren nor go dey do bad tins again.


Bikos di day to ponish dem, don kom and nobody go survive am.


Lean sinn:

Sanasan


Sanasan