Biblia Todo Logo
Bìoball air-loidhne

- Sanasan -




Jeremaya 30:6 - Holy Bible Nigerian Pidgin English

6 Naw, make una tink am well! Man fit get belle kon born pikin? So wetin make una men dey put dia hand for belle like sey dem bi woman wey won born? Wetin make evribody dey fear?

Faic an caibideil Dèan lethbhreac




Jeremaya 30:6
19 Iomraidhean Croise  

Fear katch dem well-well and dem kon dey kry with pain like woman wey won born.


So bikos of all dis tins wey I hear, my belle kon dey pain mi and e dey make mi fear. E dey pain mi like woman wey won born.


So Oga God wey diliver Abraham, dis na wetin E dey tell Jakob shidren-shidren: “My pipol, dem nor go disgrace una again and una nor go dey shame again.


Wetin una go tok wen di pipol wey una bin tink sey bi una friends katch, distroy and kon dey rule una? E go pain una like woman wey won born?


Una fit tink sey una dey save like bird wey dey rest for Lebanon cedar. But wen di wahala kom, una go kry with pain like woman wey won born.


I hear kry, like woman wey won born; shaut like woman wey dey born en first pikin. Jerusalem pipol dey find as dem go take breath and naw, dem dey kry sey, “Make una help us! Bikos na die wi dey so o-o!”


and dem go seize di town and all en strong building. For dat day, Moab sojas go dey fear like woman wey won born.


Enemies go attack Bozrah land like eagle wey spread en feada. For dat day, Edom sojas go dey fear and shake like woman wey won born.”


Damaskus pipol don weak and dem kon run, bikos dem dey fear. Dem dey feel pain like woman wey won born.


Babilon king go fear well-well wen e hear wetin en enemies tok. Wen e hear sey dem dey kom, fear and pain go nearly kill-am like woman wey won born.


I kry kon sey, “Wi don hear di news and fear dey katch us. So naw, wi dey pass thru pain like woman wey won born.


Bikos e dey fear, en face kon dey red and all en body kon dey shake.


Israel get shance to live, but dem too dey foolish to si am; just like pikin wey dem just one born, wey nor gri kom out from en mama belle.


Evribody dey fear and kry as dem si dem dey kom.


Na wons dem tif and empty evritin for di town kon turn am to where dem dey trow dirty put. Dia heart melt and dia leg kon dey shake. Honga won kill pipol and pipol face don dey shange kolour!


Wen pipol dey sey, “Evritin dey okay and peaceful,” na dat time wahala wey go skata evriwhere go kom and e go bi like di pain wey woman dey face wen e won born and nobody go eskape from am.


Lean sinn:

Sanasan


Sanasan