Biblia Todo Logo
Bìoball air-loidhne

- Sanasan -




Jeremaya 3:18 - Holy Bible Nigerian Pidgin English

18 For dat time, Israel pipol go join Judah pipol kom back from di land wey dey nort and dem go kom back to di land wey I give dia grand-grand papa as dia own propaty.”

Faic an caibideil Dèan lethbhreac




Jeremaya 3:18
22 Iomraidhean Croise  

God appear to Abram kon sey, “I go give dis land to yor shidren-shidren.” So Abram build one altar to God wey appear to am for der.


Make una nor fear, bikos I dey with una! I go bring una pipol from east and west kom house back.


I go tell di nort make dem let dem go and di sout nor go hold dem for der. Make my pipol kom from evriwhere for di world.


Instead, dem go swear sey, ‘I bi di God wey bring Israel pipol kom out from di land wey dey nort and from all di oda kountries wey I skata dem go.’ Yes! I go bring dem kom back to dia own kountry; di land wey I give dia grand-grand papa. Mi, wey bi God, don tok.”


Instead dem go sey, ‘Yu bi di God wey dey alive wey bring Israel pipol kom back from di land for nort and from di oda kountries wey Yu skata dem go.’ For dat time, dem go dey dia own land.”


God sey make I go tell Israel pipol for nort sey, “Una wey nor dey faithful, make una kom back kom meet mi. I go sorry for una and I nor go vex again! I nor go vex for una forever.


bikos time dey kom wen I go bring my pipol, Israel and Judah kom back to di land wey I give dia grand-grand papa and e go bi dia own again. Mi, wey bi God, don tok.”


Den I ansa, ‘I go bring dem back from nort kon gada dem from evry part for di eart. Doz wey blind; wey nor fit waka; wimen wey get belle and doz wey won born, go follow dem kom back too. Dem go kom back as one great nashon.


Wen dat time rish, sin nor go dey for Israel land again and wikedness nor go dey Judah, bikos I go forgive doz wey I save dia life. Mi, wey bi God, don tok.”


God sey, “Wen dat time rish, Israel and Judah pipol go kry kom find mi wey bi dia God.


Dem go ask kon follow di road wey dem dey pass go Zion. Dem go make kovenant wey nor dey end with mi and dem nor go break am.


If una stop to do all dis tins, I go allow una stay for dis land wey I give una grand-grand papa as dia propaty.


“So, make yu tell dem wetin mi wey bi God dey tok. I go gada dem kom back from di land where I skata dem go kon give dem Israel land again.


Den Judah and Israel pipol go kom togeda as one again. Dem go choose one pesin wey go lead dem and dem go plenty kon prosper for dia land again. Yes! Dat day for Jezrel, go dey great well-well!


Israel pipol surround mi with lie-lie; na wayo full Efraim, but Judah pipol still trust and dey faithful to God wey dey holy.


Make yu akuiz yor mama, Israel, bikos e nor bi my wife again and mi Oga God, nor bi en husband again.


I go plant my pipol for di land wey I give dem and nobody go fit rut dem komot again.” Na so Oga God tok.


“I go make Judah pipol strong and I go save Israel pipol. I go sorry for dem kon bring dem back to dia land. Dem go bi like pipol wey I neva rijet before. Na mi bi Oga dia God and I go ansa all dia prayers.


God tell en pipol, “Pipol wey dey nort, make una run, bikos I don skata una go evriwhere.


Lean sinn:

Sanasan


Sanasan