King Josaya remove all di juju from Israel pipol aria kon advise dem sey make dem serve God. For di time wen Josaya dey rule, di pipol nor sin against di Oga wey bi dia grand-grand papa God.
God sey, “Dis pipol sey dem dey obey mi, dem dey tok good-good tins about mi, but dem nor really dey respet mi and evritin wey dem tok nor rish dia heart. Dia relijon na law and tradishon wey human being make with dia own hand.
Dem don kontinue di wiked tins wey dia grand-grand papa dem do before, wey make dem nor obey my kommand. Demsef don dey woship oda gods. Both Israel and Judah pipol don break di kovenant wey I make with dia grand-grand papa.
Na Yu plant dem like tree kon make dia rut strong for groun and dem dey grow and bear betta fruit. Dem dey always tok about Yu even doh dem nor kare about Yu.
I wish sey my head bi like well wey wota full and my eyes bi like fountain where wota for dey rush kom out, den I go kry well-well both day and nite for my pipol wey dem kill.
Dem nor dey pray give mi with all dia heart. Instead, dem dey pritend dey kry and take body nak dia bed, just as doz wey nor know God dey do. Anytime dem dey do di korn and wine ofrin, dem dey kut demsef like sinnas and dem nor gri do wetin I tok.
“I send hot breeze kon dry all wetin una plant. Ant chop all wetin una plant for una vineyard, even una fig and olive tree too. Yet una nor still gri turn kom meet mi.” Na Oga God dey tok so.
Judah pipol don break dia promise wey dem make with God kon dey do wiked tins for Jerusalem and evriwhere for di land. Dem don dirty di temple wey God love and dia men marry wimen wey dey serve juju.