Why Yu won let Egypt pipol sey, ‘Dia God save dem with di mind to kill all of dem for di mountin kon distroy dem komot from di eart?’ Make Yu shange yor mind about wetin Yu won do yor pipol, so dat Yu nor go dey vex for dem.
Bikos e sey make my pipol go against mi, I go kill all en shidren-shidren and e nor go dey alive to si all di good tins wey I go do for my pipol. Mi, wey bi God, don tok.”
Naw, Amazaya, God dey tell yu sey, “ ‘Yor wife go turn ashawo for di town and dem go kill yor shidren for war. Dem go divide yor land kon gi-am to oda pipol and yu yorsef go die for yor enemies kountry. Dem go must take Israel pipol from dia own land kon karry dem go anoda land as slave.’ ”
Mi wey bi God wey get pawa dey look as Israel kingdom dey sin, so I go distroy dem komot for dis eart. But I nor go distroy Jakob shidren-shidren finish.
bikos di Oga una God wey dey here with una, dey jealous well-well and en vexnashon go kill and porshu evry oda tin, until E go distroy wiked pipol and sinnas komot from dis eart.