God don sey, ‘I nor send dem and dem dey lie give yu with my name.’ So E go drive yu komot and dem go kill both yu and di profets wey dey lie give yu.”
den e tok for evribody present sey, “God sey dis na how e go take break di load wey King Nebukadnezzar put for di nashons neck and E go do am before two years go finish.” So Profet Jeremaya kon waka go.
Dis na wetin go happen to dem, bikos dem sin: dem sleep with dia neighbour wife kon lie with God name. God nor like all dis tins. E know wetin dem don do and wetin dem do dey stand against dem.” Dis na wetin God tok.
Mi wey bi Israel God dey warn una. Make una nor let di profets wey dey stay among una or any oda pesin wey klaim sey e dey si tumoro, deceive una. Make una nor listin to dia dreams.
Yor profets dey lie for yu kon sey dem si vishon. Na dem make una go Babilon, bikos dem nor tell una about una sins. Instead, dem make una tink sey una nor nid to turn from una sin kom meet God.
Una dey use una lie take diskorage good pipol; pipol wey I nor like to ponish. Una nor let evil pipol shange from di bad tins wey dem dey do, so dat dem go dey save.
Dia vishon na lie and anytin wey dem tok sey go happen, nor dey happen. Dem dey sey na my message dem dey prish, but I nor send dem and dem dey espect sey wetin dem tok, go happen!
I go soon ponish una wey bi lie-lie profets, bikos wetin una dey tok, dey skata pipol. Una nor go dey der wen my pipol go gada make decision; una name nor go dey among Israel pipol and una nor go ever kom back to di land. Den una go know sey na mi bi God.
Dia profets hide dis tins like wall wey dem kover with paint. Dem dey si wrong vishon and wetin dem sey go happen, na lie. Dem dey sey na God word dem dey tok, but mi God, nor tok to dem.
But if anybody still get di mind to lie sey e dey profesai, na en own papa and mama go tell am sey, ‘Na deat go bi yor own, bikos yu dey lie with God name.’ Den if e still profesai, en papa and mama go shuk am die with swod.