One among dem wey en name na Kenaana wey Zedekaya born kon use iron make horn, den e tell King Ahab, “Dis na wetin God tok, ‘Na dis tin yu go take fight Siria pipol kon win dem finish.’ ”
Jehoiashin wey bi Jehoiakim pikin and all Judah pipol wey go Babilon as slave, I go bring dem kom back. Yes! I go break Babilon king pawa. Mi, wey bi God, don tok.’ ”
Darkness go kover Tahpanhes town wen I break and end di pawa wey Egypt get, wey make dem dey make mout and karry body up. Kloud go kover Egypt and all di pipol wey dey inside. Den sojas go katch and karry all of dem go prison.