But na only Yu Oga, bi di true God. Di God wey dey alive and Yu go rule forever. Anytime Yu dey vex, di world dey shake and nobody fit stand wen Yu dey vex.
Den God tell mi, “Tell di pipol sey mi, Israel God wey dey mighty, dey kommand dem make dem drink till di drink katch dem. Dem go dey vomit until dem fall for groun and dem nor go fit get up again, bikos I dey send war kom meet dem.
den use am take send message go give Edom, Moab, Ammon, Tyre and Sidon kings thru di pesin wey dey ripresent dem wey dem send kom si King Zedekaya, for Judah.
“Na with my mighty pawa and great strent I take kreate di eart, di pipol and di animals wey dey inside and I don give dis pawa to pipol wey I like gi-am to.
Israel God wey dey mighty dey sey, ‘I don put iron yoke for dis nashon and dem go serve King Nebukadnezzar for Babilon. I go even make wild animals serve Babilon king.’ ”