King Jehoiashin for Judah with en mama, en savants, ofisas and all en kourt workers and priests kon surenda to King Nebukadnezzar. For eight years wen King Nebukadnezzar dey rule for Babilon, e kon put Jehoiashin for prison.
Wen di year just start, King Nebukadnezzar kon give orda sey make dem bring am with di betta tins wey dey for God Temple kom Babilon. E make Zedekaya wey bi en family memba, king for en place for Jerusalem.
Di king karry all di tins wey dey God Temple go Babilon; weda di tins big or small, plus all di tins wey dem keep for God Temple, Israel kings and en ofisas store room.
I sey, “King Jekonaya go bi like pot wey break wey dem trowey. E go bi like klay pot wey pipol nor won use at-all. Why dem go force en and en shidren go anoda kountry? Wetin make dem won take dem go kountry wey dem nor know anytin about?”
Afta King Nebukadnezzar for Babilon don karry Jehoiakim pikin Jekonaya, wey bi King for Judah, en ofisas and all di pipol wey get handwork go Babilon, God kon show mi two basket wey fig fruit full for di temple front.
I rite am afta dem don karry King Jehoiashin, en mama, di ofisas for di palis, Judah and Jerusalem leaders and doz wey know work well-well, go Babilon.
God allow King Nebukadnezzar katch King Jehoiakim and e karry some of di tins wey dey God temple too. E karry Judah pipol as prisonas go Babilon and di tins wey e karry from Jerusalem, e put dem for en own juju temple.
So, from Abraham go rish David time, na fourteen generashon dey and from David time go rish wen dem karry Israel pipol go Babilon, na fourteen too and from dat time go rish wen dem born Jesus Christ, na fourteen generashon e bi.