Una go komot for di land wey I give una and I go make una serve una enemies for di land wey una nor know, bikos my vexnashon bi like fire and e go burn forever.”
I go give dem wahala sotey all di nashons for di world go fear. Pipol go laf dem well-well; use dem dey make yeye kon dey curse dem for anywhere wey I skata dem go.
But if oda nashon or kingdom nor gri serve or respet King Nebukadnezzar for Babilon, I go ponish dat nashon with war, honga, diziz and I go distroy am.
“God sey, ‘Anybody wey stay for di town go die for war or honga or diziz go kill-am. But di pipol wey go-go surenda give Babilon pipol, nor go die; dem go eskape with dia life.’ ”
Den I sey, “Dem go take all yor wifes and shidren go give Babilon pipol and yu too nor go fit eskape. Babilon king go katch yu as prisona and dem go burn dis town rish groun.”
Dis na wetin God wey get pawa dey tok: “I go send my four worse ponishment kom Jerusalem and dem bi: war, honga, wiked animals and diziz. I go send dem kon distroy di pipol and dia animals.
“But if one good man stop to do good kon dey do bad and wiked tins wey bad pipol dey do, yu tink sey e go live? No! Dem nor go remember any good tin wey e do. E go die, bikos e nor gri obey my law and e dey sin.
Tell dem sey, ‘God sey, “As long as mi wey get pawa dey alive, I nor dey happy to si doz wey dey sin, dey die. I prefer make dem stop to sin, so dat dem go get life wey nor dey end. So, Israel pipol, make una stop di wiked tins wey una dey do. Na wetin make una won kill unasef finish?” ’