Biblia Todo Logo
Bìoball air-loidhne

- Sanasan -




Jeremaya 27:12 - Holy Bible Nigerian Pidgin English

12 I tell King Zedekaya for Judah di same tin sey, “Make yu honbol yorsef kon respet Babilon king; serve en and en pipol and yu go dey save.

Faic an caibideil Dèan lethbhreac




Jeremaya 27:12
11 Iomraidhean Croise  

But anybody wey listin to mi, go dey save and e nor go get rizin to fear.


Una go komot for di land wey I give una and I go make una serve una enemies for di land wey una nor know, bikos my vexnashon bi like fire and e go burn forever.”


War or honga go kill anybody wey dey di town, but doz wey go kom out kon surenda give Babilon king, nor go die; dem go eskape with dia life.


But if oda nashon or kingdom nor gri serve or respet King Nebukadnezzar for Babilon, I go ponish dat nashon with war, honga, diziz and I go distroy am.


Dat same year, for di fift mont wey bi di fourt year wey Zedekaya bi king, Hananaya wey bi Azzur pikin, wey bi profet for Gibeon town kon tok to mi for di temple. For di priest and di pipol present, e sey,


“Israel God wey dey mighty sey: ‘I don break Babilon king pawa.


Den I tell Zedekaya, “Israel God sey, ‘Yu nor go die if yu surenda give Babilon king and dem nor go burn dis town rish groun; both yu and yor family go live.


Make una nor fear Babilon king; I dey with una and I go save una from en pawa.


Lean sinn:

Sanasan


Sanasan