Jeremaya 27:10 - Holy Bible Nigerian Pidgin English10 Make una nor listin to doz wey dey deceive una, bikos dis tin fit make dem karry una far; go where una nor know. I go drive una komot from una land and una go die for der. Faic an caibideil |
Pipol dey go meet juju priest and doz wey dey si tumoro, but dem just dey lie and deceive dem. Some dey tok wetin dreams mean, but dem dey only deceive una and na only yuzles hope dem dey give. So many pipol dey waka anyhow like sheep wey waka lost. Dem dey trobol, bikos dem nor get who dey lead dem.
Oga God sey, “I go judge pipol wey dey do majik; doz wey dey sleep with who dem nor marry; pipol wey dey tok wetin dia eye nor si; oga dem wey nor dey pay dia workers; doz wey dey opress wimen wey dia husband don die, shidren wey nor get papa and mama again and strenjas. Dem dey do like dis, bikos dem nor dey fear mi.