But una must obey mi kon make di Sabat, holy. For dat day, una must nor karry any load pass Jerusalem gate, if una do am, I go burn di gate rish round. Fire go burn di palis rish groun too and nobody go fit kwensh am.’ ”
But wen dem kom dis land kon dey stay as dia own, dem nor kon dey obey yor kommand or do wetin Yu tish dem; dem nor do wetin Yu orda dem to do and na dis make Yu distroy dem.
So, just as I distroy Shiloh, na so too I go distroy dis my temple wey una trust sey go protet una, even doh I bin gi-am to una and una grand-grand papa.
Bikos afta I don bring dem kom di land wey I promise dia grand-grand papa; di land wey get milk and honey; where dem go chop beleful kon get body, dem go turn go serve anoda god kon rijet and break my kovenant.
God nor dey lie! So di promise wey E make and ensef wey E take swear, na two tins wey nor go shange. Since wi don run go meet God make E guide us, e good make awa mind strong, so dat wi nor go fear as wi bilive en promise.