I give di leta to Eleasah wey bi Shafan pikin and Gemaraya wey Hilkaya born and na-im King Zedekaya for Judah send go meet King Nebukadnezzar for Babilon. Dis na wetin dey di leta:
For dat time, Baruk enter di temple kon stand for di gate wey bi Shafan pikin, Gemaraya di royal seketry room. Di room dey di Uppa Kourt near di New Gate. Den e read from di book, evritin wey I tok, so dat dem go hear am.
So e go di kourt seketry room for di royal palis where all di ofisas dey. Elishama, di kourt seketry, Delaaya, wey bi Shemaya pikin, Elnatan wey bi Akbor pikin, Gemaraya wey Shafan born, Zedekaya wey Hananaya born and all di oda ofisas sidan for der.
Den e tell Jerahmeel wey bi en pikin, Seraya wey Azriel born and Shelemaya wey bi Abdeel pikin sey, “Make una go arrest Jeremaya and en seketry, Baruk, kom.” But God don hide dem.
kon bring mi kom di palis kourtyard. Dem sey make Gedalaya wey Shafan pikin Ahikam born, kare for mi and make sure sey I rish house well. So I kon stay my house for Judah with di pipol wey remain.
Wen di argument kon too mush and di kommanding offisa dey fear sey dem go tear Paul to pieces, e kon orda en sojas make dem enter di meetin and karry Paul komot for der by force.
But bikos di soja offisa one save Paul life, e nor kon let dem do wetin dem plan. E kommand di pipol wey fit swim, make dem first jump komot from di ship swim go land