Biblia Todo Logo
Bìoball air-loidhne

- Sanasan -




Jeremaya 26:22 - Holy Bible Nigerian Pidgin English

22 Den King Jehoiakim send Akbor pikin Elnatan and some oda men go Egypt go katch Uriaya kom.

Faic an caibideil Dèan lethbhreac




Jeremaya 26:22
10 Iomraidhean Croise  

Wen Shaul die, Baal-Hanan wey bi Akbor son kon rule for der.


Di king kon orda Priest Hilkaya, Shafan pikin Ahikam, Mikaya pikin Akbor, Shafan wey bi di kourt seketry and Asaya wey bi di king savant sey,


So Priest Hilkaya, Ahikam, Akbor, Shafan and Asaya kon go meet Profetes Hulda wey bi Shullam wife. Shullam papa na Tikvah and na Harhas wey dey kare for di wardrobe bi en grand-papa. (Di woman dey stay for Mishneh aria for Jerusalem.) Dem go meet am kon tell am wetin make dem kom,


even from doz evil pipol wey dey evriwhere, bikos wikedness don kover di whole land.


If ruler dey listin to lie-lie word, den all en ofisas go dey plan wiked tins.


I give di leta to Eleasah wey bi Shafan pikin and Gemaraya wey Hilkaya born and na-im King Zedekaya for Judah send go meet King Nebukadnezzar for Babilon. Dis na wetin dey di leta:


So e go di kourt seketry room for di royal palis where all di ofisas dey. Elishama, di kourt seketry, Delaaya, wey bi Shemaya pikin, Elnatan wey bi Akbor pikin, Gemaraya wey Shafan born, Zedekaya wey Hananaya born and all di oda ofisas sidan for der.


Even doh Elnatan, Delaaya and Gemaraya beg di king sey make e nor burn di book, e nor listin to dem.


kon bring mi kom di palis kourtyard. Dem sey make Gedalaya wey Shafan pikin Ahikam born, kare for mi and make sure sey I rish house well. So I kon stay my house for Judah with di pipol wey remain.


Seventy Israel leaders dey der, plus Jaazanaya wey bi Shafan pikin. Each of dem whole wetin dem take dey burn incense and smoke dey kom out from am.


Lean sinn:

Sanasan


Sanasan