“Wen Hezekaya bi king for Judah, Profet Mikah from Moreshet profesai give di pipol. E tell dem sey, ‘God sey, “ ‘ “Dem go klear Zion like field; Jerusalem go turn where dem dey trowey dirty put and di temple hill go turn forest.” ’
Dis na di message wey God give Mikah wey kom for Moreshet town about Samaria and Jerusalem, for di time wen King Jotam, Ahaz and Hezekaya dey rule Judah.
Den one Farisee wey dem dey koll, Gamaliel, wey dey tish di law and wey di pipol dey respet well-well kon stand up tok, “Make una send dis men go outside first.”