But with all dis tins, di pipol go against Yu. Dem nor gri obey Yu and dem turn from yor law. Dem kill di profets wey kom warn and tell dem to turn kom meet Yu. Dem curse Yu many-many times,
Israel God wey dey mighty tok: “I go soon ponish dis town and di oda towns wey surround am, bikos una sturbon well-well and una nor gri listin to wetin I tok.”
“So, mi wey bi Israel God dey ask, ‘Wetin make una dey distroy unasef? Nobody among una wey kom here from Judah go survive: weda na man or woman, pikin or di shidren wey dem just born. Dem go distroy all of una finish.
Why una dey woship juju and sakrifice give Egypt gods? Na bikos una dey stay der? Abi una nor know sey una dey make mi vex? Una dey distroy unasef and na dis make all di nashons for di eart dey trit una anyhow kon use una name as curse!
Make una nor bi like una grand-grand papa dem. Before-before, my profets prish give dem sey, make dem stop to sin and do evil, but dem nor gri listin or obey dem.
Dem don make mi dey vex for di gods wey dem dey serve; dem don make mi dey vex well-well with tins wey nor mean anytin: So, I go make dem jealous doz wey nor bi human being: I go make dem vex well-well for kountry wey nor get sense.