Biblia Todo Logo
Bìoball air-loidhne

- Sanasan -




Jeremaya 25:6 - Holy Bible Nigerian Pidgin English

6 Dem sey make una nor woship or serve oda gods and make una nor make God vex bikos una dey woship juju. So, if una obey God, E nor go ponish una.

Faic an caibideil Dèan lethbhreac




Jeremaya 25:6
17 Iomraidhean Croise  

Judah pipol sin well-well and dem kon make God vex pass as E vex for dia grand-grand papa.


God enter agriment with Israel pipol sey, “Una must nor woship anoda god. Make una nor bow, serve or offa sakrifice to dem.


So make una nor use silva or gold take make any oda god join mi.


Make una nor serve any oda God apart from mi.


Dis tin go happen, bikos from di biginnin kon rish naw, Israel and Judah pipol don disobey and make mi vex, bikos of wetin dem do.


I send my savant, di profets kom meet una sey make una stop di bad tins wey una dey do kon do di korrect tin. Dem warn una sey make una nor woship and serve oda gods, so dat una go kontinue to stay for dis land wey I give una and una grand-grand papa, but una nor gri listin or hear dem.


“So, mi wey bi Israel God dey ask, ‘Wetin make una dey distroy unasef? Nobody among una wey kom here from Judah go survive: weda na man or woman, pikin or di shidren wey dem just born. Dem go distroy all of una finish.


Why una dey woship juju and sakrifice give Egypt gods? Na bikos una dey stay der? Abi una nor know sey una dey make mi vex? Una dey distroy unasef and na dis make all di nashons for di eart dey trit una anyhow kon use una name as curse!


Make una stop to opress di strenjas among una; shidren wey nor get papa and mama and wimen wey dia husband don die. Make una stop to kill innocent pipol and woship oda gods, bikos e go distroy una.


Una dey tif; kill; dey sleep with who una nor marry; dey lie; dey swear; dey offa sakrifice give juju and dey woship gods wey una nor know before.


But I go love and sorry for Judah pipol. Mi wey bi dia Oga God, go save dem, but e nor go bi thru war, swod, bow, arrow, horse or doz wey dey ride di horse dem.”


den wetin dem show una kon happen. If dem sey, “Make una kom make wi woship oda gods; gods wey una neva sey before.”


Make una nor turn from any of dis kommand wey I dey give una today or go follow and woship oda gods.


Una must nor woship any of una neighbour gods apart from God ensef,


But if una forget di Oga una God for evritin kon dey follow oda gods, dey woship and bow for dem, I go tell una today sey, God go really distroy una.


If una forget God kon go woship anoda god, E go turn against una; E go bring wahala kom meet and distroy una, even doh E trit una as pikin before.”


Lean sinn:

Sanasan


Sanasan