Israel God wey dey mighty tok: “I go soon ponish dis town and di oda towns wey surround am, bikos una sturbon well-well and una nor gri listin to wetin I tok.”
“For twenty-three years, from di thirtint year wey Amon pikin, Josaya bi king for Judah kon rish naw, na-im God don dey tok to mi and I nor dey fail to tell una wetin E tok, but una nor gri listin.
My savants wey I send kom meet una, make una dey listin to evritin wey dem tell una. I dey always send dem kom meet una, but una nor gri listin to dem.
I go ponish yu, yor shidren-shidren and all yor ofisas, bikos of di sin wey all of una kommit. Yu or Jerusalem and Judah pipol nor gri listin to my warnin. So I go bring di wahala wey I bin tell una about, kom.’ ”
Make una nor bi like una grand-grand papa dem. Before-before, my profets prish give dem sey, make dem stop to sin and do evil, but dem nor gri listin or obey dem.
Make sure sey una dey obey di Pesin wey dey tok to una! Bikos if Israel pipol wey nor gri hear dia oga Moses word for eart nor eskape, how wi go fit eskape, if wi nor gri hear di Pesin wey dey tok to us from heaven?