Jeremaya 25:34 - Holy Bible Nigerian Pidgin English
34 Una wey bi leaders and my pipol shepad, make una shaut kry well-well! Make una mourn and roll for san-san, bikos di time don rish wen dem go kill una kon kut una like goat
Wen di year just start, King Nebukadnezzar kon give orda sey make dem bring am with di betta tins wey dey for God Temple kom Babilon. E make Zedekaya wey bi en family memba, king for en place for Jerusalem.
Pesin wey dey spoil pipol waka nor betta pass doz wey don die, bikos nobody spoil am. Di pesin wey dey deceive odas nor betta pass who don die, even doh nobody deceive am. Wen yu don spoil and deceive pipol finish, oda pipol go spoil and deceive yu too.
Na dia blood and flesh full God swod like sey na lamb, goat or animal wey dem take do sakrifice. God go do dis sakrifice for Bozrah town and E go kill Edom pipol well-well for di land.
I sey, “King Jekonaya go bi like pot wey break wey dem trowey. E go bi like klay pot wey pipol nor won use at-all. Why dem go force en and en shidren go anoda kountry? Wetin make dem won take dem go kountry wey dem nor know anytin about?”
“E go bad well-well for doz leaders wey suppose kare for my pipol just as shepad dey kare for en sheep, but dem nor do am, instead dem distroy and skata my pipol.
God sey, “I go take una back as my shidren kon give una betta land; di land wey fine pass for di whole world. Den una go koll mi, ‘Papa’ and una nor go turn from mi again.
I still sey, “My pipol! Make una wear sak klot and roll for groun. Make una kry well-well and mourn like sey una only pikin just die. Bikos very soon, doz wiked sojas go kom distroy all of us.”
Edom pipol wey dey stay for Uz land, make una dey laf naw. Make una know sey dis judgement cup go rish where una dey too; una go drink from am until di drink don shark una and una go kon naked.
God sey, “Bikos I dey vex for doz strenjas wey dey rule my pipol, I go ponish dem well-well. Judah pipol na my own and mi wey bi di God wey dey mighty go kare for dem. Dem go bi my strong shariot.
Make una si as doz wey dey lead di pipol dey kry, bikos dia glory don vanish! Make una listin as lions dey shaut, bikos dem don distroy di bush where dem dey stay, near Jordan River!