Biblia Todo Logo
Bìoball air-loidhne

- Sanasan -




Jeremaya 25:33 - Holy Bible Nigerian Pidgin English

33 For dat day, di pipol wey God kill, dia body go skata for difren part for di world. Nobody go mourn for dem and nobody go karry dem go beri. Dem go dey groun like manure wey dem gada.

Faic an caibideil Dèan lethbhreac




Jeremaya 25:33
19 Iomraidhean Croise  

Wetin remain for Jezebel body, go skata like dirty for Jezrel land and pipol nor go fit know am at-all.’ ”


Blood dey flow like wota for evriwhere for Jerusalem and nobody remain wey go beri doz wey dem kill.


Dem die for Endor and dia body kon make di grass grow well.


God dey vex for en pipol and E don ready to ponish dem. Mountins go shake and pipol wey die, dem go leave dia dead body for street like dirty. God vexnashon nor go end for der, but E go still ponish dem.


Wiked and bad pipol wey dey di world, E go ponish dem with fire and swod kon kill dem well-well.


Den, put dem under sun, moon and stars. Bikos dis na di tins wey dem love; tins wey dem dey woship, serve and koll make e kom guide dem. Nobody go gada dis pipol bones go beri again; so dem go bi like manure wey dem pour for groun.


“I don polish my swod, bikos I won use am take kill. I go gi-am to di pesin wey go kill pipol.


I go hook yor jaw and fish for river go whole yu tit. Den, I go drag yu komot from Nile River with all di fish wey dey yor mout.


I go trow yu and all di fish inside desert. Yu go die for der and nobody go beri yu. Den I go give yor body to bird and animals make dem chop.


God sey, “Ethiopia pipol, I go kill all of una with my swod.”


And for three and half days, all di pipol, tribes, language and nashons go dey look dia dead body. Dem nor go allow anybody beri dem.


Lean sinn:

Sanasan


Sanasan