Jeremaya 25:26 - Holy Bible Nigerian Pidgin English
26 di kings for nort both far and near and all di kingdoms wey dey dis eart. Afta all of dem don drink from God vexnashon cup finish, Babilon king must drink from am too.
‘I go koll di pipol wey dey nort and my savant King Nebukadnezzar for Babilon and dem go kom fight against Judah pipol and di towns wey dey round Jerusalem. I go distroy and skata dis nashon and di ones wey dey round am, forever. I go make pipol si and dey fear dem.
“All di prince for nort plus Sidon pipol dey der too. Even with all di pawa wey dey make pipol fear before, dem still die with shame kon go join doz dead body wey dem nor sekonsaiz.”
Instead make dem honor una, na disgrace go follow una and na una by unasef go drink kon stagga fall. God go make una drink from una own ponishment cup and una honor go turn to disgrace.