Wen dat day rish, Israel pipol wey dey Assyria, Patros, Sudan, Elam, Babilon, Hamat, di towns wey dey near di sea and Egypt, God go use en pawa take bring dem kom back to Jerusalem.
I si one bad vishon sey, “Di pesin wey dey lie, go lie well-well and di one wey dey distroy, go distroy well-well. Elam sojas, make una attack! Media sojas, make una hide attack di towns! But God go end all dis wahala.”
So God go use Media kings take distroy Babilon. E go revensh bikos of en temple wey Babilon sojas distroy. Media sojas oga kon kommand sey, ‘Make una sharp una arrow and karry una shield!
Prepare di nashons make dem go fight against Babilon pipol. Send messenjas make dem go koll Media kings, dia leaders, ofisas and di sojas for all di kountries wey dem dey kontrol.
“Elam dey der and all en sojas grave dey round am. Dem kill all of dem for war and dem neva sekonsaiz dem before dem die go where dead body. Wen dem dey alive, dem dey make wahala, but naw, all of dem don die with shame.