Dis na wetin God wey mighty tok about Edom: “Teman pipol nor sabi judge well again? Who dey advise Edom nor fit tell dem wetin dem go do? Abi all dia sense and wisdom don vanish?
I go ponish Egypt, Judah, Edom, Ammon, Moab and di pipol for desert wey kut dia hair short for di temple. Even for Israel, nobody wey dem sekonsaiz, keep my kovenant for en heart.”
Naw, I don tok sey I go ponish Edom kon kill evribody with dia animals for der. I go distroy dia land from Teman town go rish Dedan town and di pipol go die for war.
Rhodes pipol dey buy and sell with una; many pipol wey dey stay near sea dey give una ivory and eboni wood, so dat una go give dem some of wetin una get.