den use am take send message go give Edom, Moab, Ammon, Tyre and Sidon kings thru di pesin wey dey ripresent dem wey dem send kom si King Zedekaya, for Judah.
Dem go distroy en horse and shariot. Sojas wey dem hire from oda land, go dey fear and dem go weak like woman. All dia betta-betta tins go skata and pipol go tif and karry di ones wey remain.
Edom pipol wey dey stay for Uz land, make una dey laf naw. Make una know sey dis judgement cup go rish where una dey too; una go drink from am until di drink don shark una and una go kon naked.
Dis na di towns wey Filistia pipol leaders for bring di gold sore wey dem offa to God, so dat E go forgive dem dia sin: Ashdod, Gaza, Ashkelon, Gat and Ekron.