Di mountin dey make nois like wen many sojas dey mash! Strong wahala dey among di kingdoms and nashons dey gada togeda! Oga God wey dey lead heaven sojas, dey gada dem togeda to go fight.
Oda pipol go help Israel pipol kom back to dia land. Israel pipol go kom back to di land wey God give dem and pipol go serve dem. Den Israel pipol go opress doz wey bin katch dem kon rule di pipol wey bin sofa dem.
Bikos I dey bring many strong nashons from di nort and dem go attack and distroy Babilon. Wen dia strong sojas shot dia arrow, e go-go meet and kill who dem shot am to! Dem nor dey miss at-all.
So, make una run komot Babilon town! Make una run for una dear life! Make una nor die for nor-tin, bikos of Babilon pipol sin. I dey take my revensh and I go ponish dem well-well.
Di time to ponish Israel don rish; di time wey pipol go get wetin dem deserve. Dat time, Israel pipol go know wen e happen! Una sey, ‘Dis profet na fool. Dis man wey feel sey e know well-well, dey kraze!’ Una hate mi well-well, bikos una sin too many.