But God wey strong and get pawa, dey my side. So doz wey dey plan against mi, go fail. Yu go disgrace dem forever, bikos dem nor go susid and dem nor go ever forget di disgrace.
I go give dem wahala sotey all di nashons for di world go fear. Pipol go laf dem well-well; use dem dey make yeye kon dey curse dem for anywhere wey I skata dem go.
Bikos Israel God sey, ‘Just as I pour my vexnashon and fire for Jerusalem pipol, na so too, I go pour my vexnashon for una head, if una go Egypt. Pipol go si una dey fear, dem go hate and use una name as curse. Una nor go ever si dis place again.’
So naw, make yu bear di shame wey dey kom. Yor sins bad pass yor sistas own, sotey if dem look yu, dem go sey, ‘Wi nor even do anytin.’ Naw, make yu bear yor shame and pain, bikos yu don make yor sistas bi like good pesin.”
Before-before, Yu dey defend us. So make Yu nor vex for Jerusalem again, bikos na yor town and holy hill, e bi. Doz wey dey stay near us, dey look Jerusalem kon dey laf yor pipol, bikos of awa sin and di wiked tins wey awa grand-grand papa dem do.