I go ponish yu, yor shidren-shidren and all yor ofisas, bikos of di sin wey all of una kommit. Yu or Jerusalem and Judah pipol nor gri listin to my warnin. So I go bring di wahala wey I bin tell una about, kom.’ ”
Yor profets dey lie for yu kon sey dem si vishon. Na dem make una go Babilon, bikos dem nor tell una about una sins. Instead, dem make una tink sey una nor nid to turn from una sin kom meet God.
But if anybody still get di mind to lie sey e dey profesai, na en own papa and mama go tell am sey, ‘Na deat go bi yor own, bikos yu dey lie with God name.’ Den if e still profesai, en papa and mama go shuk am die with swod.