My Oga God nor dey really stay dis eart! If evriwhere for di sky and di heavens wey high pass nor fit kontain Yu, den how dis temple wey I build go bi to Yu?
True-true! Who fit really build temple for am, since di sky and di heavens wey high pass too small for am? Who I bi to build temple for am? E go just bi where dem go for dey offa sakrifice gi-am.
God nor dey really stay with human being for dis eart! Si, if di sky and di heavens wey high pass nor rish Yu stay, den how dis temple go take kontain Yu?
Pipol wey dey try to hide dia plans from God, nor betta pass doz wey don die! Dem dey hide do dia work for korna, dey tink sey nobody dey si or know wetin dem dey do, bikos dem dey boast sey, “Who dey si us? Who know wetin wi dey do?”
Na mi bi di high and holy God, di Pesin wey go live forever. Where I dey stay, dey high and holy, but I still dey stay with pipol wey dey honbol and ready to turn from sin kom meet mi, so dat I go give dem mind and hope again.
But I don naked Esau shidren-shidren finish kon open where dem hide put, so dat dem nor go fit hide again. Dem don distroy Edom pipol and nobody among dem remain.
God kon ask mi, “Man pikin, yu si wetin Israel leaders dey hide do? All of dem dey woship for one room wey juju full. Dem dey sey, ‘God nor dey si us! E don leave dis land.’ ”
God ansa, “Israel and Judah pipol don sin well-well. Dem don kill pipol for di land and dem nor dey obey my law again. Dem sey mi God don leave dem and I nor dey si wetin dem dey do.
Yu nor fit kompare God with anybody for dis world. E dey do wetin E like with di angels for heaven and pipol for dis world. Nobody fit shalenge or ask am, “Wetin Yu tink sey Yu dey do?”