King Ben-Hadad ofisas kon tell am, “Na gods for mountin bi Israel pipol gods, naim make dem fit win us. But wi go win dem, if wi fight dem for ordinary groun.
One profet go meet King Ahab kon sey, “Dis na wetin God tok: ‘Bikos Siria pipol tok sey I bi god for mountin and nor bi for groun, I go make yu win dia many sojas and yu and yor pipol go know sey na mi bi God.’ ”