Biblia Todo Logo
Bìoball air-loidhne

- Sanasan -




Jeremaya 23:20 - Holy Bible Nigerian Pidgin English

20 E nor go end until E don do evritin wey E plan to do. Di time dey kom wen di pipol go undastand all dis tins well.”

Faic an caibideil Dèan lethbhreac




Jeremaya 23:20
18 Iomraidhean Croise  

Den Jakob koll all en sons kon sey, “Make all of una kom, so dat I go tell una wetin go happen for future.


make Yu still listin to yor pipol prayer. If dem turn kom meet Yu for dat land kon pray and konfess dia sin and di wiked tins wey dem don do, my Oga God, make Yu hear dia prayers.


Plus all dis ones, God still dey vex for Judah, bikos of all di wiked tins wey Manasseh do.


God sey, “Just as I komot Israel from my eye, na so too I go komot Judah pipol. I go rijet dis town wey I choose, both Jerusalem and di temple wey I sey, ‘I go stay.’ ”


Yor wisdom, brain and undastandin nor mean anytin if God dey against yu.


God wey dey lead heaven sojas swear sey, “Make una know sey na as I plan am, na so e go bi and as I tok am, na so e go happen too.


Na so e bi too with di word wey I dey tok; e go must do wetin I plan for am. E go must do evritin wey I send am make e kom do.


En vexnashon nor go stop until E don do evritin wey E plan to do. Afta sometaim, en pipol go undastand all dis tins. One day, una go undastand wetin I mean.


Bikos of dis, di eart go kry and di sky go black, bikos God don tok sey na so e go bi and E nor go shange en mind.”


Make una give sign make dem go attack Babilon. Give di guide pawa kon put dem for dia pozishon, den una go hide some men for bush too!’ God don do wetin E sey E go do to Babilon pipol.


“I dey sharp and klean swod to take kill pipol. I polish am and e dey shine like tonda lite. “Make my pipol dey happy? No! Dem nor fit, bikos dem don rijet all di warnin wey I give dem.


Den evribody for di world go know sey, mi wey bi God don draw my swod kom out and nor-tin go let mi put am back.’


But evritin wey I tok thru my profets, happen to una grand-grand papa dem, just as I tok am. So dem turn from sin kom meet mi kon sey, ‘Oga God wey dey lead heaven sojas, na en really ponish us, just as wi deserve am. E don do wetin E sey E go do.’ ”


For dat time, wen una dey trobol and all dis tins don happen to una, una go turn kom meet di Oga una God kon obey all en kommand


Lean sinn:

Sanasan


Sanasan