Biblia Todo Logo
Bìoball air-loidhne

- Sanasan -




Jeremaya 23:19 - Holy Bible Nigerian Pidgin English

19 But just look, God vexnashon go kom like heavy breeze and e go blow wiked pipol head komot.

Faic an caibideil Dèan lethbhreac




Jeremaya 23:19
19 Iomraidhean Croise  

God go swip dem trowey kwik-kwik, even before pot wey dem put for fire, go dry.


Dat time, trobol go kom meet una like heavy breeze and una pain go sirious well-well.


Wen heavy breeze dey blow, e go blow wiked pipol trowey, but pipol wey dey tok trut, dey always dey save.


Dis message na about Babilon. Just as strong breeze dey blow kom from desert, Na so wahala go kom from one land wey pipol dey fear.


Dem bi like yong plants wey just dey grow kom out wey pipol rut trowey. Wen God send en breeze kom, di flower dey dry and blow komot like grass.


Di nois go loud rish evriwhere for di eart. Bikos God get wetin E one tok against di nashon. E go judge evribody kon kill wiked pipol. Mi, wey bi God, don tok.”


God wey dey mighty sey, “Wahala go kom meet di nashon one-by-one and strong breeze go gada for where di world for end.


God vexnashon go kom like heavy breeze! Like strong breeze wey go blow wiked pipol head komot.


En vexnashon nor go stop until E don do evritin wey E plan to do. Afta sometaim, en pipol go undastand all dis tins. One day, una go undastand wetin I mean.


“For dat time, dem go tell Jerusalem and Judah pipol sey, “ ‘I dey kommand one strong breeze kom from di desert kom meet my pipol. Di breeze nor bi to blow well or to klean my pipol,


God sey, “I go distroy Babilon and en pipol with strong breeze.


As I dey look, I si strong breeze dey blow kom from nort and tick kloud with tonda lite dey round am. Fire still dey der too and I si one tin dey shine inside di fire.


Naw, dis na wetin God wey get pawa dey tok: “As I dey vex, I go send strong breeze with rain and big-big stone kon skata di wall.


So, I go skata Rabbah town kon burn all dia strong-strong buildings rish groun. Wen di war start, pipol go dey shaut and e go bi like wen heavy breeze dey blow and strong rain dey fall.


Instead, I go skata and karry dem go difren kountry like sey na heavy breeze blow dem. Den dis betta land go turn where pipol nor dey stay again and where dem dey trowey dirty put.”


God go appear on-top en pipol; E go shot en arrow like tonda lite. God wey get pawa go blow di trumpet; E go mash kom from sout under one heavy rain.


Lean sinn:

Sanasan


Sanasan