Biblia Todo Logo
Bìoball air-loidhne

- Sanasan -




Jeremaya 22:9 - Holy Bible Nigerian Pidgin English

9 Den, some go ansa, ‘Na bikos dem forget dia kovenant wey dem make with dia God kon go serve and woship oda gods.’

Faic an caibideil Dèan lethbhreac




Jeremaya 22:9
16 Iomraidhean Croise  

Dis temple go skata and anybody wey waka pass, go sopraiz. Dem go sey, ‘Wetin make God do dis land and dis temple like dis?’


Dis tins go happen, bikos dem don forget mi kon dey offa sakrifice give oda gods and dem dey make mi vex, bikos of di juju wey dem make with dia hand. Una go feel my vexnashon for dis place and una nor go fit stop am.” ’


Dem don rijet mi kon dey sakrifice give oda gods, so I dey vex for wetin dem do. I dey vex naw for Jerusalem and nor-tin go fit stop mi make I nor ponish dem.” ’


Dem don kontinue di wiked tins wey dia grand-grand papa dem do before, wey make dem nor obey my kommand. Demsef don dey woship oda gods. Both Israel and Judah pipol don break di kovenant wey I make with dia grand-grand papa.


Tell dem sey, ‘Di Oga wey bi Israel God sey, “Curse go follow doz wey nor gri obey di kovenant.”


Den make yu tell dem, ‘God sey, “Na bikos una grand-grand papa rijet mi kon go woship oda gods. Dem forget mi and nor gri obey my law.


Evribody wey si dem, dey attack dem. Dia enemies sey, ‘Nobody go ponish us for wetin wi do dem, bikos dis pipol don sin against di Oga God wey go give dem rest and wey dia grand-grand papa trust.’


God ansa, “Dis tins happen, bikos my pipol rijet di law wey I give dem. Dem nor gri obey or do wetin I sey make dem do.


But I go let some of dem survive di war, honga and diziz, so dat dem go tell di nashon where dem dey stay naw, about all di yeye tins wey dem do. Den, dem go know sey na mi bi God.”


Yu go si di real rizin why I dey do wetin I dey do.” God wey get pawa don tok.


All di kountries go know sey Israel go Babilon as slave, bikos of sin and I turn leave dem kon let dia enemies beat and kill dem for war.


Wen I vex kom ponish una, all di nashons near una, go fear. Dem go shake dia head and laf as dem dey look una.


Den all di nashons go ask, ‘Wetin make God do all dis tins for dis land? Wetin make God dey vex like dis?’


Lean sinn:

Sanasan


Sanasan