Jeremaya 22:3 - Holy Bible Nigerian Pidgin English3 Dis na wetin God tok: “Make una do wetin dey good and korrect. Make una protet pesin wey dem dey opress from who dey opress am. Make una nor trit or opress strenjas; doz wey nor get papa and mama or wimen wey dia husband don die and make una nor kill innocent pipol for dis land. Faic an caibideil |
Oga God sey, “I go judge pipol wey dey do majik; doz wey dey sleep with who dem nor marry; pipol wey dey tok wetin dia eye nor si; oga dem wey nor dey pay dia workers; doz wey dey opress wimen wey dia husband don die, shidren wey nor get papa and mama again and strenjas. Dem dey do like dis, bikos dem nor dey fear mi.
“E go bad for una wey dey tish di law and una Farisee pipol, una wey dey pritend! Una dey give one out of evry ten tins wey una get, but una nor dey do di important tin wey di law tok, wey bi to give korrect judgement, to trit pipol well and to do wetin dey good! Una suppose to dey do dis tins join di oda one.