Biblia Todo Logo
Bìoball air-loidhne

- Sanasan -




Jeremaya 22:29 - Holy Bible Nigerian Pidgin English

29 Judah land, Judah land, Judah land! Make una listin to wetin God won tok:

Faic an caibideil Dèan lethbhreac




Jeremaya 22:29
9 Iomraidhean Croise  

Pipol from evry nashon, make una kom! Make una gada kon listin. Make evribody for di world listin.


Pipol for dis eart! Make una hear dis word: ‘I won bring wahala for dis pipol. E go bi payment for dia wikedness, bikos dem don rijet my law and dem nor gri listin to wetin I tok.


E kon sey, “Tok to di bones. Tell di bones sey make dem listin to wetin God dey tok.


Make pipol for evriwhere listin! Make evribody wey dey for dis world, listin to wetin I dey tok. God wey get pawa dey tok against una and E dey kom judge una from en holy temple.


“But make yu rite dis song for yorsef kon tish evribody for Israel. Make sure sey dem know am, so dat dis song go bi my witness against dem!


Heavens make una listin to mi as I dey tok; eart make una listin to di words wey I won tok so.


I koll heaven and eart as witness today against una. If una break di kommand wey God give una thru mi, una go die for di land wey una won cross Jordan River enter. Una go stay der small; den God go distroy una finish.


Lean sinn:

Sanasan


Sanasan