Biblia Todo Logo
Bìoball air-loidhne

- Sanasan -




Jeremaya 22:28 - Holy Bible Nigerian Pidgin English

28 I sey, “King Jekonaya go bi like pot wey break wey dem trowey. E go bi like klay pot wey pipol nor won use at-all. Why dem go force en and en shidren go anoda kountry? Wetin make dem won take dem go kountry wey dem nor know anytin about?”

Faic an caibideil Dèan lethbhreac




Jeremaya 22:28
20 Iomraidhean Croise  

Wen Filistia pipol dey run, dem run leave dia juju and David and en men kon karry dem komot.


King Jehoram na thirty-two years wen e bi king and e rule for eight years from Jerusalem. En deat nor pain anybody at-all and dem beri am for David Town, but nor bi for di royal beri groun.


Pipol don forget mi like sey I don die; like sey I bi pot wey break.


Anytime I dey strol outside di town, doz wey dem kill for war, na dia dead body I dey si for road and wen I enter di town, I go still si sey pipol dey die, bikos dem nor si food chop. Profet and priest dey do dia work, but dem nor know wetin dem dey do.”


Den God tell mi, “Even if Moses and Samuel stand here dey beg for dis pipol, I nor go listin or sorry for dem. So make yu take dem komot for my front kon tell dem make dem dey go!


And naw, una sin even worse pass dia own. All of una sturbon, wiked and nor dey obey mi.


Una go komot for di land wey I give una and I go make una serve una enemies for di land wey una nor know, bikos my vexnashon bi like fire and e go burn forever.”


Yu go like to kom back to dis kountry, but yu nor go ever kom back again.”


God sey, “Make yu rite dis man name as pesin wey nor get pikin and wey nor go ever susid for life. En shidren nor go ever rule for David throne for Judah again.”


Afta King Nebukadnezzar for Babilon don karry Jehoiakim pikin Jekonaya, wey bi King for Judah, en ofisas and all di pipol wey get handwork go Babilon, God kon show mi two basket wey fig fruit full for di temple front.


wen Nebukadnezzar, Babilon king kon karry Judah King, Jehoiashin wey bi Jehoiakim pikin and en ofisas for Judah and Jerusalem, go Babilon as slave.


King Nebukadnezzar for Babilon kon put Zedekaya wey bi Josaya pikin, as king for Judah, instead of Jehoiashin wey bi Jehoiakim pikin.


On-top Moab house and for di meetin place, na only pipol wey dey mourn and kry dey der, bikos I don break Moab like pot wey pipol nor won use again.


Even doh Israel dey grow like betta grass, I go send hot desert breeze from east kom dry dia rivers and well. E go distroy evritin wey dem value.


Israel pipol bi like oda nashons naw and dem dey yuzles like pot wey break.


Lean sinn:

Sanasan


Sanasan