“Judah pipol, make una nor kry and mourn for di king wey dem kill. But make una kry well-well for di one wey dem go karry go Babilon, bikos e nor go kom back to di land where dem for born am again.”
Dis na wetin God tok about Josaya wey bi Shallum pikin, wey take-ova from en papa as king, before dem karry am go Babilon. God sey, “E nor go ever kom back to dis land again.
I sey, “King Jekonaya go bi like pot wey break wey dem trowey. E go bi like klay pot wey pipol nor won use at-all. Why dem go force en and en shidren go anoda kountry? Wetin make dem won take dem go kountry wey dem nor know anytin about?”
Jehoiashin wey bi Jehoiakim pikin and all Judah pipol wey go Babilon as slave, I go bring dem kom back. Yes! I go break Babilon king pawa. Mi, wey bi God, don tok.’ ”
Bikos Israel God sey, ‘Just as I pour my vexnashon and fire for Jerusalem pipol, na so too, I go pour my vexnashon for una head, if una go Egypt. Pipol go si una dey fear, dem go hate and use una name as curse. Una nor go ever si dis place again.’
Judah pipol wey kom stay Egypt, nobody among dem go eskape or survive. Nobody among dem go-go back to Judah, wey dem like to go stay again. Nobody go-go back, escept some slave.’ ”