Den e tell Solomon, “My pikin, I kommand yu sey make yu know yor papa God and make yu use all yor mind and heart take serve am. E know all wetin wi dey tink and wetin wi wont. If yu go meet am, E go take yu, but if yu turn from am, E go abandon yu forever.
Make una learn to do good; make una make sure sey una dey judge well; make una help doz wey dem dey opress. Pipol wey nor get papa and mama, make una give dem wetin dem wont and make una help wimen wey dia husband don die.”
Dem don fat and dey chop betta food. Dem nor know wen to stop all di bad tins wey dem dey do. Dem nor dey give doz wey nor get papa dia rite or give betta judgement to doz wey dem dey opress.
If anybody won boast, make e boast sey e know and undastand mi, bikos my love dey forever and I dey do wetin dey korrect and true. I like pipol wey dey do dis kind tin. Mi, wey bi God, don tok.”
God sey, “Dis pipol bi like sojas wey don ready dia bows. Dem always dey ready to lie, bikos of dis, dem don get pawa for di land, but na wayo dem take get am. Dem don do many bad tins and dem nor dey tink of mi wey bi dia God.
Dis kind pipol dey sey dem know God, but di way wey dem dey live dia life, show sey dem nor know am, bikos dem get bad mind, dey disobey God and dem nor ever dey like betta tin.