Jeremaya 22:11 - Holy Bible Nigerian Pidgin English
11 Dis na wetin God tok about Josaya wey bi Shallum pikin, wey take-ova from en papa as king, before dem karry am go Babilon. God sey, “E nor go ever kom back to dis land again.
Wen King Josaya still dey rule, Fero Neko wey bi Egypt king with en men kon go River Eufrates go support Assyria king for war. King Josaya and en men go fight dem, but wen King Neko si am for Megiddo, e kon kill-am.
King Josaya savant karry en oga dead body from Megiddo on-top horse go back to Jerusalem for where dem for beri am for en grave. Di pipol for di land take Josaya pikin, Jehoahaz, pour olive oil for en head kon make am king for Judah.
Jehoahaz na twenty-three years wen e start to rule and e rule from Jerusalem for three monts. En mama name na Hamutal wey bi Jeremaya from Libnah, pikin.
Zabud wey bi Jehohanan pikin, Berekaya wey Meshillemot born, Jehizkaya wey bi Shallum pikin and Amasa wey Hadlai born kon go meet doz pipol wey dey kom back from war
So Priest Hilkaya and di oda pipol wey di king send with dem kon go meet Profetes Hulda wey dey stay di new part for Jerusalem. (En husband na Shallum wey Tokhat born and na Hasrah wey dey kare for di temple robe, bi en grand-papa.) Dem kon tell di woman evritin wey happen,
Dis na di message wey God give Zefanaya for di time wey Amon pikin, Josaya bi king for Judah. Kushi wey bi Gedalaya pikin, naim bi Zefanaya papa and na Amaraya wey bi Hezekaya pikin, born Gedalaya.