Biblia Todo Logo
Bìoball air-loidhne

- Sanasan -




Jeremaya 2:9 - Holy Bible Nigerian Pidgin English

9 “Bikos of dis, mi God go tell una wetin I get against una and una shidren-shidren.

Faic an caibideil Dèan lethbhreac




Jeremaya 2:9
12 Iomraidhean Croise  

E dey koll di heavens wey dey up and di eart wey dey under, so dat dem go bi witness wen E dey judge en pipol.


Make una nor bow or serve dem, bikos na mi bi di Oga una God and I dey jealous well-well. I bi God wey dey ponish shidren and dia shidren-shidren, bikos dia papa Rijet mi.


God don dey ready to judge. Yes! E don ready to judge en pipol.


Make una remind mi of di good wey una do; make wi tok di matter togeda; make una tok as una take good.


So wetin make una dey komplain? All of una don sin against mi!” Mi, wey bi God, don tok.


una still sey, ‘Wi neva do any bad tin at-all, so God nor go vex for us again.’ But make una look! I go make sure sey I judge una, bikos una sey, ‘Una neva kommit any sin.’


Even for dia mama belle, Jakob struggol with en broda Esau and wen Jakob grow, e still struggol with God.


Make yu akuiz yor mama, Israel, bikos e nor bi my wife again and mi Oga God, nor bi en husband again.


Israel pipol, make una hear wetin God dey tok! God dey akuiz evribody for Israel sey: “For dis land, nobody love mi, dey faithful or si mi as en God.


mi mysef go turn against dat man and en family. I go remove am from my pipol, both en and all di pipol wey follow am woship dat juju wey dem dey koll Molek.


Naw, make di mountins listin to God! E get kase against en pipol. E go tok wetin Israel pipol do.


Lean sinn:

Sanasan


Sanasan