Biblia Todo Logo
Bìoball air-loidhne

- Sanasan -




Jeremaya 2:37 - Holy Bible Nigerian Pidgin English

37 Una go kover una face with shame and sorrow wen una dey kom back from Egypt, bikos God don rijet di pipol wey una trust and even with dia help, e nor go still betta for una.”

Faic an caibideil Dèan lethbhreac




Jeremaya 2:37
16 Iomraidhean Croise  

So David ansa, “Make yu stay here today and tumoro, den I go send yu go back.” So Uriaya stay for Jerusalem dat day and di next day.


Den Tamar put shako for en head, tear en gown kon use en hand kover en face as e dey kry dey go.


Na God ensef dey lead us. En priest dey here won blow trumpet, so dat wi go kon fight una. Israel pipol, make una nor fight against una grand-grand papa God, bikos una nor go fit win.”


Una nor go get anywhere to go dan to knee down with prisonas or to sleep with doz wey dem don kill. And with all dis, God still dey vex and E dey ready to kill dem with en own hand.


Di agriment wey una make with deat, nor go work again and dem go kansol di one wey una enter with dead body. Wen judgement go kom like strong wave, e go karry una go.


Rish pipol send dia savant go fetch wota for well, but dem nor si wota fetch, so dem kom back with dia empty kontaina. Dem kover dia face, bikos dem dey shame and dey konfuse.


Rain nor fall since so dia land dey strong and doz wey dey plant, don taya and dem nor know wetin to do.


God sey, “I go curse di pipol wey leave mi kon go trust human being. Pipol wey depend on flesh and blood for dia pawa.


Wetin make una dey waka anyhow and dey shange una ways? Just as Assyria pipol disgrace una, na so too Egypt pipol go do una.


Jerusalem pipol, make una shaut and mourn as una dey go Lebanon. Make una kry go Bashan land; make una shaut well-well for Moab mountins, bikos dem don distroy una propaty.


God sey, “Make yu rite dis man name as pesin wey nor get pikin and wey nor go ever susid for life. En shidren nor go ever rule for David throne for Judah again.”


Dem go take Zedekaya go Babilon and e go stay der until I don deal with am finish. Even if e fight Babilon pipol, e nor go win. Mi, wey bi God, don tok.’ ”


Naw, awa eyes dey pain us well-well, bikos wi dey wait for pipol to kom help us. But wi just dey wait for nor-tin, bikos dem nor go fit help us.


But Moses ansa dem, “Den why una kon dey disobey God? Una nor go fit win!


Lean sinn:

Sanasan


Sanasan