Jeremaya 2:35 - Holy Bible Nigerian Pidgin English
35 una still sey, ‘Wi neva do any bad tin at-all, so God nor go vex for us again.’ But make una look! I go make sure sey I judge una, bikos una sey, ‘Una neva kommit any sin.’
Di pipol ask, “Wetin make us dey fast and honbol awasef if God nor go ansa us?” God kon tell dem, “Di true bi sey, for di time wey una dey fast, una still dey opress una workers and run follow tins wey una like.
“Wen yu don tell di pipol about all dis tins, dem go ask, ‘Why God won ponish us like dis? Wetin wi do? Wish kind sin wi kommit wey make di Oga awa God dey vex?’
How una won take sey wi dey klean and wi neva woship Baal. Make una si as una sin for Hinnom Valley! Si evry tin wey una do! Una bi like woman kamel wey dey sleep with difren man kamel.
Di nois go loud rish evriwhere for di eart. Bikos God get wetin E one tok against di nashon. E go judge evribody kon kill wiked pipol. Mi, wey bi God, don tok.”