Biblia Todo Logo
Bìoball air-loidhne

- Sanasan -




Jeremaya 2:33 - Holy Bible Nigerian Pidgin English

33 Una really know how to run follow di pesin wey una love and bikos of dis, even ashawo, don learn join en work, bikos of wetin una dey do!

Faic an caibideil Dèan lethbhreac




Jeremaya 2:33
12 Iomraidhean Croise  

But Manasseh deceive Judah pipol and doz wey dey stay for Jerusalem make dem for sin pass di nashons wey God distroy komot der, for dem.


How una won take sey wi dey klean and wi neva woship Baal. Make una si as una sin for Hinnom Valley! Si evry tin wey una do! Una bi like woman kamel wey dey sleep with difren man kamel.


Yong woman dey forget to wear en gold ring? Abi woman wey won marry, dey forget to wear en marriage klot? But e don tey wey my pipol don forget mi.


Poor and innocent pipol blood don stain una klot, even doh una nor katch dem dey tif for una house. Yet, with all dis tins wey una don do,


Wetin make una dey waka anyhow and dey shange una ways? Just as Assyria pipol disgrace una, na so too Egypt pipol go do una.


Naw, I don raiz my hand won ponish yu kon take yor share for di blessing, komot yor hand. I don give yu to Filistia pipol; pipol wey hate yu and dem nor like di life wey yu dey live.


Yu like as yu dey do di bad tins wey dem do? No! But e nor even tey before yor own worse pass dia own.


I go ponish am for all doz times wey e forget mi kon dey burn incense give Baal and dey run follow en lovers with all di gold wey e wear. Mi, wey bi God, don tok.


Lean sinn:

Sanasan


Sanasan