Wen e si di shain for en sista hand and di ring for en nose kon hear wetin en sista tok wen e sey, “Dis na wetin di man tok”, e run go meet di man for where e for still stand near en kamels. Laban kon tell am,
Jerusalem pipol dey happy, bikos of wetin God don do. E bi like yong woman wey dem dress ready for marriage. God don wear salvashon and viktory klot for en body.
Dis wiked pipol nor gri obey mi. Dem dey follow dia sturbon and wiked heart kon dey woship and serve oda gods. So dem go bi like dis nika wey nor get value again.
But my pipol don forget mi, dem dey burn incense give juju and na dis make dem fall komot for di way wey dem suppose follow. Dem nor dey follow di road wey I show dem, instead dem dey follow di road wey nor smooth at-all.
No oda nashon don ever shange dia god, even wen dem know sey dia gods nor bi god at-all. But my pipol don shange mi God wey give dem honor, with gods wey nor go fit help dem.
“I dey hear one nois on-top di hill: Na Israel pipol dey kry and beg dia juju. True-true, dem dey stay inside sin and don forget di Oga wey bi dia God.
Some of una dey kill pipol, bikos of money. Some dey put intrest for di money wey dem borrow dia kountry man and dem dey get plenty gain thru dat one. Dem don forget mi.” Dis na wetin God wey get pawa tok.
Israel pipol build royal palis, but dem don forget who kreate dem. Judah pipol don build many strong town, but I go send fire go burn dia palis and di towns rish groun.”
But Israel pipol kon fat and wiked more-more. Di pipol kon heavy, round and tick for body! Dem forget God wey kreate dem; den kon rijet di Rock wey bi dia salvashon.