Biblia Todo Logo
Bìoball air-loidhne

- Sanasan -




Jeremaya 2:16 - Holy Bible Nigerian Pidgin English

16 Yes! Memfis and Egypt sojas don distroy Israel glory and dem nor dey fear mi again.

Faic an caibideil Dèan lethbhreac




Jeremaya 2:16
17 Iomraidhean Croise  

Si, yu really dey bilive sey Egypt pipol go kom help yu? Egypt wey bi like shuku-shuku; if pesin won rest put, e go wound di pesin hand. Dat na wetin King Fero for Egypt dey do to evribody wey dey trust am.


Fero Neko katch am put for prison for Riblah wey dey Hamat land, so dat e nor go fit rule Jerusalem pipol. Neko sey make di pipol for di land pay am 7,500 pound for silva and 75 pound for gold.


Zoan and Memfis leaders na fools. Na dem suppose lead di nashon, but bikos dem nor know di rite way, dem dey lead di pipol anyhow.


Wi don fight, rijet and refuse to follow Yu. Wi opress odas kon turn from Yu. All wetin wi dey tok and tink, na lie dem bi.


Dem go distroy Judah like wota wey distroy tins. Dem go spread dia feada kon kover di land and sey, ‘O Immanuel.’ ”


God tell mi about Israel pipol wey dey stay for Migdol, Tahpanhes, Memfis and all di oda towns wey dey Egypt sout.


“Make yu shaut am for Egypt, Migdol, Memfis and Tahpanhes sey, ‘Make una ready to defend unasef, bikos dem go kom fight and distroy evritin where una get!’


Egypt pipol, make una ready to go Babilon as slaves! Dem go turn Memfis to desert and e go bi dirty land where nobody dey stay.


Pipol wey nor get house kon find help go Heshbon, di town wey King Sihon dey rule before, but fire don burn di town. Fire don burn doz wey dey give Moab pipol hope.


God wey get pawa sey, “I go distroy and skata di juju wey dey Memfis. Nobody go ever rule Egypt again and I go make all di pipol fear.


I go burn Egypt town and evribody for Pelusium go dey kry with pain. I go break Tebes wall rish groun kon kover di town with wota.


Even if dem eskape distroshon for Assyria, Egypt sojas go kill dem and Memfis pipol go beri dem. Grass and shuku-shuku go grow kover all di place where dia house and silva dey.


Moses pray for Gad tribe sey: “God go bless una wey make en land wide! Gad pipol bi like lion wey won tear pesin hand or head komot from en body.


Lean sinn:

Sanasan


Sanasan