Biblia Todo Logo
Bìoball air-loidhne

- Sanasan -




Jeremaya 2:13 - Holy Bible Nigerian Pidgin English

13 bikos my pipol don kommit two difren sin against mi: dem don leave mi wey bi di spring wey dey give dem fresh wota and dem dig one well for diasef wey nor fit keep and gada wota.

Faic an caibideil Dèan lethbhreac




Jeremaya 2:13
49 Iomraidhean Croise  

Dis tins go happen, bikos dem don forget mi kon dey offa sakrifice give oda gods and dem dey make mi vex, bikos of di juju wey dem make with dia hand. Una go feel my vexnashon for dis place and una nor go fit stop am.” ’


bikos na Yu bi di wota wey dey give life; di lite wey make us dey si.


As I tink about evritin wey human being dey do for dis world, I kon sey: Evritin dey yuzles; e just bi like sey pesin dey porshu breeze.


Di tisha sey, “Evritin dey yuzles! Yes, evritin really dey yuzles!”


So di tisha sey, “Evritin dey yuzles. Yes! Dem yuzles well-well.”


But as I sidan dey tink of evritin wey I don do, I si sey all of dem dey yuzles. Dem bi like wen pesin dey porshu breeze! E nor really get anytin wey pesin fit gain for dis world.


Some pipol work with wisdom; with wetin dem know and with dia skill; but dem go still die leave evritin for anoda pesin wey nor work at-all. Dis tins dey yuzles and nor dey good at-all.


God dey give wisdom, knowledge and joy to pipol wey dey do wetin E wont. But if pesin wey dey sin get money and propaty well-well, God go take dem from am kon gi-am to pesin wey dey do wetin E wont. All dis tins dey yuzles too and dem bi like wen pesin dey porshu breeze.


Den I tink of all di work wey pipol dey do and I kon si sey, evritin wey dem dey do, na to know who betta pass. But all dis tins dey yuzles too, e just bi like wen pesin dey porshu breeze.


Melu know en owner, donkey sef know who dey gi-am food, but Israel wey bi my pipol nor know or undastand mi at-all.”


Una own don finish like who don die, bikos una pipol dey kommit sin. Una don spoil finish and dey do evil tins! Una sins dey bring una down, bikos una don rijet di Holy Pesin, wey bi Israel God kon turn against am.


As wota dey make pesin wey dey hongry for wota, happy, na so too I go happy wen God save mi.”


so dem go karry una komot una land bikos una nor undastand. Una leaders go hongry till dem die and una pipol nor go si wota drink.


Why una dey spend una money for wetin nor go beleful una? Why una dey spend una money wen una know sey hongry go still kill una? Make una listin and do wetin I tok, den una go enjoy di best food.


God sey, “Dem bi my pipol and dem nor go lie give mi.” E save dem


Like dis, I go ponish my pipol for Jerusalem and Judah, bikos of dia wikedness. Dem forget mi kon dey woship and offa sakrifice give juju and oda gods wey dem make with dia own hand.


Rish pipol send dia savant go fetch wota for well, but dem nor si wota fetch, so dem kom back with dia empty kontaina. Dem kover dia face, bikos dem dey shame and dey konfuse.


Una don rijet and turn from mi and na dis make mi vex kon bring wahala for una. I don taya to dey sorry for una.”


Na Yu bi di hope wey Israel get; so make Yu disgrace doz wey leave Yu. Make dem disappear like name wey dem rite for san, bikos dem forget Yu wey bi di spring wey dey bring fresh wota.”


Snow dey finish on-top Lebanon rock? Or wota wey dey flow for mountin dey ever stop?


I go do am, bikos di pipol don forget mi kon dirty dis place as dem dey sakrifice give gods wey dem or dia grand-grand papa or Judah kings nor know and dem kill innocent pipol for here too.


No oda nashon don ever shange dia god, even wen dem know sey dia gods nor bi god at-all. But my pipol don shange mi God wey give dem honor, with gods wey nor go fit help dem.


But na Israel pipol kause all dis tins, bikos dem leave di Oga wey bi dia God, even wen E dey show dem di korrect road.


So God sey, “Just as dem dey disgrace tif wen dem katch am, na so too I go disgrace Israel pipol, dia kings, ofisas, priests and profets, bikos of wetin dem do.


But God sey, “My pipol foolish well-well, dem nor know mi at-all. Dem bi shidren wey nor get sense and dem nor dey kwik undastand anytin. Na only bad-bad tins dem sabi do.”


Wiked men dey stay among my pipol, dem dey wait like pipol wey dey spread net to katch bird or set trap to katch pipol.


Di profet dem dey lie; di priests dey rule as dem like and my pipol like am like dat. But di day wey wahala and distroshon go start, na where dem go run go for help?


All dis juju don make Israel pipol turn from mi, but afta I don ansa dem, I bilive sey dem go turn back kom meet mi.


Den di man bring mi kom di temple front and I si wota dey kom out from under di gate dey rush go east; di place wey di temple face. E dey flow well for di sout-side for di temple near di altar.


But till naw, my pipol dey tok against mi like sey I bi dia enemy! Doz wey trust mi, una tif dia klot kon let dem look like pipol wey dey kom from war.


My pipol, wetin I do una? Wetin I do wey make una taya for mi? Make una ansa mi naw!


God sey, “For dat day, I go open one place where wota go for rush kom wosh David shidren-shidren and Jerusalem pipol from all dia sins and all di bad-bad tins wey dem dey do.


Jesus ansa am, “If yu know wetin God gift bi and di pesin wey dey ask yu for wota so, yu for ask am and e go give yu di wota wey dey make pesin live forever.”


Di woman ask am, “Oga God, yu nor get bucket and di well deep well-well, where yu go fit get dat kind wota?


But anybody wey go drink from di wota wey I go gi-am, nor go hongry for wota again, bikos di wota wey I go gi-am, go turn to river wey nor dey dry inside en belle and di wota go gi-am life wey nor dey end.”


For di last day for di feast, wey bi di biggest day, Jesus stand kon shaut, “If wota dey hongry anybody, make e kom meet mi.


Den God tell Moses, “Yu go soon die, den di pipol go kon dey sin with strenj gods for di land where dem dey go. Dem go rijet mi kon break my kovenant wey I make with dem.


Dis pipol bi like river wey nor get wota, dem bi like kloud wey breeze dey blow anyhow and na dem God dey keep di place wey dark pass, dey wait.


E still tell mi, “God don do am finish! Na mi bi di Alfa and Omega, di startin and di ending. Anybody wey dey hongry for wota, I go gi-am wota wey dey give life and e nor go pay.


Den di angel show mi di river wey dey give life. Di river klear like crystal and e dey pour kom from God and di Lamb throne.


Di Spirit and di Bride sey, “Kom!” Make di pesin wey hear sey, “Kom!” And anybody wey wota dey hongry, make e kom; di pesin wey wont di wota wey dey give life, make e drink from am free of sharge.


But una still leave mi kon dey woship oda gods, so I nor go save una again.


Den Israel pipol kry to God sey, ‘Wi know sey wi don sin, bikos wi don forget Yu and wi dey serve juju and Ashtoret image. Abeg! Make Yu kom save us from awa enemies hand and wi go serve Yu forever.’


Lean sinn:

Sanasan


Sanasan